The Welder Wey Reject Hook Up
There was this welder called Emeka for Ikeja. HK to the bone.
Work from Monday to Sunday. Even Sunday evening e dey grind.
One afternoon, one aunty enter his workshop. Big car, big gold, big perfume.
`"Young man, I like your work. Make we hook up. I go pay you well."`
Emeka look her, look his welding machine, then laugh.
`"Aunty abeg, I dey respect you. But my own hook up na electrode and metal.
If you get gate, tank, or railing make I weld, I dey. But that other hook up, I no do."`
Aunty vex. Call am "bush man" and drive off.
3 months later, aunty come back. This time no perfume, no car.
`"Emeka abeg help me. My husband vex comot. My gate spoil and tenants dey threaten to leave."`
Emeka just nod. `"No wahala aunty. I go fix am."`
He welded the gate solid. Even painted am. Charged her normal money.
After he finish, aunty talk:
`"Why you no collect my first offer? You for don chop money by now."`
Emeka wipe sweat: `"Because HK no dey sell dignity for kobo.
God dey see. Today na gate, tomorrow fit be contract."`
2 weeks later, aunty’s brother - na big developer - call Emeka.
`"I hear say you be honest welder. I get 20 houses wey need railings. You fit handle am?"`
Emeka collect the job. Hire 3 boys. Move workshop.
_Moral: When you reject wrong hook up, correct connection go hook you up._
--
